Krazy Rymz - Know Thyself [Version]

In this life you gats know yourself
You gats know say na only you fit help yourself
The kind life wey you want na only you fit give yourself
Oyi
If I be you I no go dull myself

Omo thank God for life o
Thank God for street o
Thank God for Mummy o
Thank God for Daddy o
Thank God for Paddy o
Thank God for Baby o
If no be God o
Na where man for dey o
Man for don Kpeme
Thank God for life
Them say what nor kill you
Can only make you stronger

In this life you gats know yourself
You gats know say na only you fit help yourself
The kind life wey you want na only you fit give yourself
Oyi
If I be you I no go dull myself

No dull yourself o
Ah ah ah
I no go dull myself o
Ah ah ah
I no go dull myself o
Ah Ah Ah
Na me fit help myself
Na me fit stop myself o
Ah Ah Ah

Here we go
Feel my flow
Na who know man dey kill am go
You see this life brother take am slow
Cos if you hurry You go fall for road
I be idoma boy wey dem born for south
Echi de de la'nor ho weh mah
We hustle every day from 6 to 6
Cos your hustle na your salary
Omo no long story
Salt no be sugar
Help yourself before you help another
Person wey work e suppose to chop
And hand wey plant suppose harvest
So many things we see wey the mouth no fit talk
So many things we talk but the eyes no fit see
Dem no dey tell person say the rain don dey fall
A word dem say is enuf for the wise
Le Le Le o

In this life you gats know yourself
You gats to know na ony you fit help yourself
The kind life wey you want na only you fit give yourself
If I be you I no go dull myself

No dull yourself o
Ah Ah Ah
I no go dull myself o
Ah Ah Ah
I no go dull myself o
Ah Ah Ah
Na me fit help myself
Na me fit stop myself o
Ah Ah Ah

Yeh
Dem say man wey work suppose to chop life
NorNor dey ya so

Written by:

Publisher:
Lyrics © O/B/O DistroKid

Lyrics powered by Lyric Find

Krazy Rymz

View Profile