Michael XtReMe - Kale

For this life nobody holy
As i need you na so you need me Odeshi no dey work for missile
If you think say you strong omo na six feet
Life don teach me many lessons
Sometimes e be like say na something dey use you
Even your girlfriend go even dey confuse you
Your head dey bang so many things just dey stress you
But after all na the same one place All of us go end one day
So do your best wey your strength fit take
Cos you no fit ever do all
For here we only get one life to live
No one fit boast of wetin e no fit see
Sometimes life go just tire you
So many things wey man dey do life go just tire you
You feel like giving up
Life go just tire you
But am looking up to jah
Life go just tire you

Kale kale make i blow out some Kale kale make
I blow out some kale Kale kale make
I blow out some kale Kale kale make i blow out some kale

Some fake friends go dey mock you from behind
Dem see you and be faking up the smile
Dem no want make dem ever see you shine
But Oluwa go dey steady make you rise
Everything for this life na vanity So nothing is really worth dying for
Cos everything go surely come and surely go
Do your best and leave a legacy behind
I no go see you con dey fum say i too holy
Con dey fum say no be woman born me
Everybody for this life get em story
No con dey judge me if you see me with my kpoli
I know I know I no perfect but i get sense
Oh lord i be sinner I be sinner Sometimes life go just tire you
So many things wey man dey do Life go just tire you You feel like giving up
Life go just tire you But am looking up to jah
Life go just tire you
Life go just tire you

Kale kale make i blow out some kale Kale kale make
I blow out some kale Kale kale make
I blow out some kale Kale kale make i blow out some kale

Written by:
Michael Aneke

Publisher:
Lyrics © O/B/O DistroKid

Lyrics powered by Lyric Find

Michael XtReMe

View Profile