Charles Golden - Prayer

I pray
Make blessings come my way
As I dey e no easy for me
Lord watch my steps
Without you I'm noting
Lord I'm praying

Story story
Story of my life
The things when I go yan
No go think say I dey lie
Baba God really good he dey try
He bless me everyday
with the things when I dey like
Oniovo check am nah
No be by my power but I still deh alive
But I still dey alive
No be by my power and I still dey alive
Okay
In the morning when I wake up I dey pray
Baba God me I wan start again
Oh lord
Please abeg bless my hustle for the day
Make e plenty for the boy
Make I hustle see my gain
Try dey watch your back with prayer
If you too go loyal turn your back
Dem go stab am
My bro dem go stab am
Thought you were my brother damn
If you gat my back
Then I no suppose dey bother
Funny how time flies
Rest in peace all the pains I had
The struggle no be play
Brother man life hard
I dey light my blunt
Anytime I'm sad
This life is like a cinema movie
You gotta watch it to the end
To find out the meaning
Lord I can't see my back
But I can see my front
Protect my footsteps
As I go beyond
Lord I pray
Make blessings come my way
As I Dey e no easy for me
Lord watch my steps
Without you I'm nothing
Lord I'm praying

No Dey compare me
I Dey compete with myself
Never can I fall
This na prayer to my self
Who Dey check am
Shaybe na bible talk am
Who Dey work na dey chop
Hustle make nobody stop am
Every day for man life
Man Dey see shege
Man keep mouth shut
Man can't say shit
GOD abeg God abeg
You you know na only you
Na some of us get
Your goodness and mercy sure for me
So I no Dey fear
Who Dey wish me bad
Lol you go condemn
Na oluwa raise me up
Hand no fit deh reach there
So my guy calm down
If you get update share
Abi you no go like if all of us
Gather flex this is why they say
One care no dey form convoy
Abi you no go like if all of us
Gather flex this is why they say
One care no dey form convoy
Lord I pray
Make blessings come my way
As I dey e no easy for me
Lord watch my steps
Without you I'm nothing
Lord I'm praying

Written by:
Charles Joseph

Publisher:
Lyrics © O/B/O DistroKid

Lyrics powered by Lyric Find

Charles Golden

View Profile
Golden Treasury of Hymns Golden Treasury of Hymns