Samzy scopy - E go trust woman

Talon be kosi werey

Wetin kill am
E go trust woman o
E go trust woman o
E go trust hin girlfriend wey just enter school
E go trust babe o
Wetin kill am
E go trust woman o
E go trust woman o
E go trust hin girlfriend wey just enter school
E go trust babe o

E get one day wey i sit down for my room dey practice
E get one matter wey be sey i wan settle for Francis
I dey engrossed to the music wey be sey i dey practice
But i con dey wonder why my padi con sit down dey cry since
I con dey ask my padi sey wetin con be the matter
Hin sey make i leave am jor sey make i no dey mind am
Everything wey i dey do I pack am
Because i need to make my padi calm down
Hin sha tell me sey na because of hin girlfriend hin dey cry o
And if na that girl matter i swear my padi dey try o
My padi open complex for am even buy am phantom
Carry am go dubai why hin go con leave am how come
Hin sey the girl tell am sey guy i never loved you
Naso my padi burst cry tell am god go judge you
For your information i'm married to this person eweeyy
My padi enter hin room go drink poison

Wetin kill am
E go trust woman o fear that gender
E go trust woman o fear that gender
E go trust hin girlfriend wey just enter school
E go trust babe o
Wetin kill am
E go trust woman o fear that gender
E go trust woman o fear that gender
E go trust hin girlfriend wey just enter school
E go trust babe o

Written by:
Samuel Onabiyi

Publisher:
Lyrics © O/B/O DistroKid

Lyrics powered by Lyric Find

Samzy scopy

View Profile