2 Fly - Tribute For ZEE

I no believe say I no fit to see you again my brother
Say the news wey I get on the 1st, e strike pass thunder
This matter long and e pass anaconda
If money fit bring you back I for fund am
Cos you show me this love in abundance
Wetin my mouth fit to talk ooh
This your matter gimme shock oo eh
Chai
I first ask if na whyning ni
Dem for find something else use Dey whine me oh
Make nobody tell me say make I no cry
Me I no fit give it up ooh I don try
I first ask if na whyning oh
Dem for find something else use Dey whine me
Started from the bottom and this far wey we come e be God
Many plans but no plan to be gone so soon
This thing Dey worry me
Feel In my tummy and e hurt to my bone ni gan
The kind of love wey you show me my bro
No other friend wey don show me before
Wetin my mouth fit to talk ooh
This your matter gimme shock oo uhmmmmmm
I first ask if na whyning ni
Dem for find something else use Dey whine me oh
Make nobody tell me say make I no cry
Me I no fit give it up ooh I don try
I first ask if na whyning oh
Dem for find something else use Dey whine me
Network Dey but you no signal me say you Dey go
We suppose link I tell you say I go show
Network Dey but you no signal me say you Dey go oh
We suppose link I tell you say I go showwwwww
Yeah my bro since you kick bucket,
This tears wey I cry e fit full bucket e oh
I need Shayo wey pass turbo king
All your guys are not doing okay
Yeah my bro since you kick bucket,
This tears wey I cry e fit full bucket e oh
I need Shayo wey pass turbo king
All your guys are not doing okay

Written by:
Winner Igbozurike

Publisher:
Lyrics © O/B/O DistroKid

Lyrics powered by Lyric Find

2 Fly

2 Fly

View Profile