Leanball - I No Mind

I no mind
O wai
Baby I dont mind
No

I no care if na bow or you get k leg
I no send if your ynash get stretch mark
I no care if your papa name na paulinus
Or even if your mama dey sell ugu or agbalomo
I no mind if na real or na fake bobbie
I no send if na black or na pink lip
I no care whether you go school for oxford
Or even if you be elementary school dropout
I no mind if na face me I go face you
I no care if you dey live with like eight crew
I no send whether you sneeze on me like achew
See I no mind if na garri me and you dey chew

I no mind
O wai
Baby I dont mind
No

I no mind if you get pikin with another man
I no care if you be friend with like many men
I no send if you pretend say you in love with man
See I no care even if you no get any hand
I no mind even even if your mouth dey smell
I no care even if you say you no like nacking
I no send even if we dey so far apart
I no mind because na only you wey dey my heart
I no care whether you be igbo or yoruba
I no care whether you fulani or hausa
I no send whether na kogi state or calabar
And I no mind whether you oyo or anambra

I no mind
O wai
Baby I dont mind
No

I no mind
O wai
Baby I dont mind
No

I no mind whether you sabi book or you no sabi
I no mind whether you call me baller or you call me papi
I no mind whether you be lepa or you be orobi
I no mind hmm
Baby I no mind
I no mind whether you sabi xook or you no sabi
I no mind whether you call me kika or you call me crazy
I no mind whether you be yellow or you be blackie
Uhn see see
I no mind

I no mind
O wai
Baby I dont mind
No

I no mind
O wai
Baby I dont mind
No

I no mind
O wai
Baby I dont mind
No

Written by:
Kika Egbarin

Publisher:
Lyrics © COSON

Lyrics powered by Lyric Find

Leanball

View Profile
333 - EP 333 - EP