TeeBee - Swegbe

Everybody get their own tory to dey tell
You cannot be more than what you are shotiye!
Make you listen cos you know say i no go pretend
i go talk my mind, you know say me i no do dey care
See i no come try do gra gra for here
Na person wey no sabi
Na en dey ask for address
Anything fit happen so make your eye dey clear
Shey you understand wetin you dey hear
Fire fire fire fire fire fire eh
Everybody go dey run
Fire fire eh
If you look our face, omo you fit to see the pain
Be like say dem dey use us to play
Fire fire fire fire fire fire eh
Everything go dey burn
Fire fire eh
Them talk say the money don disappear
Be like say dem dey use us to play

Swegbe na swegbe o
Eh eh eh eh
Swegbe o
Pako na pako
Pako
Swegbe na Swegbe
Eh eh eh eh
Swegbe o
Pako na pako
Pako

Na still the matter we dey solve
Everybody gather for the centre make we talk
Omo e don do
Make them talk
Our mumu don do
We go talk, talk, talk, talk
No be today we dey endure
Them dey promise things wey we never see before
After elections dem go start dey ignore
Be like say dem want to do us like before

Yes
Right now, i go tell you wetin Swegbe dey mean...you see any person wey no sabi en work na Swegbe
Sho get?

Them go show themselves well well
Dem go do nonsense
(Kia kia)
Dem go leave their work swegbe
Come dey talk nonsense
(la go)
Dem must to show themselves well well
Dem must talk nonsense
(La go)
Nothing dey their head
(Mumu)
Dem go do nonsense
(La go)
Baby sempe o
Rolling dollar bi ti fatai o
Awon temi no dey tire o
Mi o raye gbogbo walahi
Hmmm
Pay me my money o
I sabi work no be today o
Original bi ti pako o
Me i don yarn you the koko o

Swegbe na swegbe o
Eh eh eh eh
Swegbe o
Pako na pako
Pako
Swegbe na Swegbe
Eh eh eh eh
Swegbe o
Pako na pako
Pako

Na Swegbe o
Swegbe
Na pako o
Pako
Na Swegbe
Eh eh eh
Hmmm
Na pako
Pako

Written by:
Franklin Robert-Maduekwe, Olutobiloba Osobu, YAO

Publisher:
Lyrics © O/B/O DistroKid

Lyrics powered by Lyric Find

TeeBee

TeeBee

View Profile