BenG Piano - Wahala

Farabale no go rush am
Cover am make dem no cast am
My people dem don go far
Na yeye government dey give us stress
If you buy Benz na big offense
Olopa dem go jump your fence
If you get money you get many friends
Las las money stop nonsense

Wahala dey naija
Suffer dey naija
Hunger dey naija
Sapa dey naija
Wahala dey naija o
Corruption dey Naija
Bandit dey naija
Na bad government dey kill naija
Ewooo

Somebody should help me
My country is unfriendly
You suppose be my friend
Because police is not my friend
Since 1960 the same decease
20 ten 20 rest in peace
To the heroes wey we miss
For Lekki toll gate don't forget

Wahala dey naija
Suffer dey naija
Hunger dey naija
Sapa dey naija
Wahala dey naija o
Corruption dey Naija
Bandit dey naija
Na bad government dey kill naija
Ewooo

Baba FELA talk am before
Monkey dey work while Baboon dey chop
Our politicians no get policy
Na the democracy dey make us crazy
Killing Stealing and Kidnaping
Make my people die for nothing
The same people wey don rule before
Na the same people wey still rule today
Nothing don change for their system
ASUU strike dey for the students
Cup of garri we no fit buy
We dey suffer we still smile
No electricity Insecurity
Dem enter church dey kill in our community
Na our money wey dem dey use dey shine
Dem dey use am buy cars decorate their compound

Wahala dey naija
Suffer dey naija
Hunger dey naija
Sapa dey naija
Wahala dey naija o
Corruption dey Naija
Bandit dey naija
Na bad government dey kill naija
Ewoooh

Written by:
Benjamin Ukoh

Publisher:
Lyrics © O/B/O DistroKid

Lyrics powered by Lyric Find

BenG Piano

View Profile