Gil Joe, Dave Cobs and Mark Success - Toll Gate

20:10:20
Government cause nemesis
But that's just genesis
Of the people dem wan kill
Won't lie this people we miss
Oh yeah
Wetin our eyes e don see
We no go hide we go talk
all the blood wey dem suck
God e get eyes He dey see
God e get eyes He dey see yeah yeah!


7:30pm 20:10:20
Naija soldiers storm youths for lekki
Dem talk say na lie we dey lie
But mama still dey cry for her child
Plenty citizens of this country
Lost their lives while singing National anthem o
Why they so heartless I don't know
na dem know
Dem no go stop
I dey try but I no fit chop
Who their families wan report
Wen na government we're running from
cnd if you think say my people dey wrong
For exercising their rights to the law
I've got no choice but to pray for ur soul
Cuz you're the problem I have in this song
have in this song yeah
20:10:20
Government cause nemesis
But that's just genesis
Of the people dem wan kill
Won't lie this people we miss
Oh yeah
Wetin our eyes don see
We no go hide we go talk
all the blood wey dem suck
God e get eyes He dey see
God e get eyes He dey see yeah yeah!
Hmm somebody pour me water
Hmm komot this tears for their eyes
Na we be the future leaders
Why dem wan come stop our ginger
God no dey sleep for the matter
God go come change all the matter
God save our brother and sister
God save our father and mother
Hm ah dat one dey o
Everything e go set one day o
God already dey on top the matter
E no too far, He go concur
So many things wey dem talk dem wan do wan do hmm!
Don go voice mail voice mail hmm!
Where the conscience conscience hmm!
Dem prefer to dey kill us
Shey na because we want a better life
These men wan end our lives
We see proof for insta live
Oh yeah yeah!

Written by:

Publisher:
Lyrics © Songtrust Ave

Lyrics powered by Lyric Find

Gil Joe, Dave Cobs and Mark Success

View Profile