Styl-Plus - Baby Mo

Ai baby no
Styl Plus io eh
She wan chop this our money
Our money io

Baby mo
Omo mo be so
You wan play me wayo
I no be oyinbo
You no fit chop my money go
You no fit carry my ego oh oh
You no fit chop my money go
You no fit carry my ego oh oh

Wetin my eye don see o
If I talk am e go hard to believe o
The matter come dey make me dey wonder
Whether the thing wey dey worry the girl na long throat or hunger
Because e meet me for Park and Shop io
E think say e go take me chop io
E wan turn guyman to mugu
You can't turn Urhobo man to mugu
Baby say e dey hungry I say I know
I take am go Iya Basira place o
She look the place she say nawa o
Me sef I tell am

Baby mo (Baby mo)
Omo mo be so (No)
You wan play me wayo
I no be oyinbo
You no fit chop my money go (Chop my money go)
You no fit carry my ego oh oh (You no fit carry my ego)
You no fit chop my money go (You wan chop my money go)
You no fit carry my ego oh oh (You no fit o not my ego)

Wetin I see with my eye o
If I talk am you go say I dey lie o
The matter come dey really confuse me
I dey wonder if she dey gbadun my style or she just wan use me
Because she meet me for one nightclub io
She come dey find as she go take me chop io
The baby think say she dey fast
Tishe Luku no dey ever take last
Baby ask for shoe I say yes oh
I take am straight to Tejuosho
As we reach the place she say nawa o
Na so I tell am o

Baby mo (Nwa mmo)
Omo mo be so (Haba haba)
You wan play me wayo (Wayo)
I no be oyinbo
You no fit chop my money go (Baby mo)
You no fit carry my ego oh oh (You no fit carry my ego)
You no fit chop my money go (You wan chop my money no no no)
You no fit carry my ego oh oh (Lekwa nune chichi o)

Whether dem like am o
Whether dem dislike am oh oh
The thing be say e don dey tey wey I know say dem wan chop my money
Dem dey look me like Obama
Dey find how dem go take me hammer
The thing be say they don forget say I grow for Naija not for Yankee
These girls dem no know me
Omo ile Oluji
She manipulate me and separate me from my money
E no easy o
You go lie you go cry you go try
But e no easy o baby baby mo

Baby mo (Baby mo)
Omo mo be so (Omo mo be so)
You wan play me wayo (Wayo)
I no be oyinbo
You no fit chop my money go (You no fit chop my money)
You no fit carry my ego oh oh (No no you no fit carry am go)
You no fit chop my money go (Eh baby emi)
You no fit carry my ego oh oh (Moti soji iwo gan oje soji)

Baby mo
Omo mo be so (No)
You wan play me wayo (No)
I no be oyinbo
You no fit chop my money go (My money go go go go)
You no fit carry my ego oh oh (My ego go go go)
You no fit chop my money go (My money go go go go)
You no fit carry my ego oh oh (My ego go go go no)

Written by:
AKINTUNDE BABATUNDE AKINSANMI, OLASUNKANMI OMOLAYE, SHIFIKOVIE ADOGHO EMOEFE, ZEALOUS ONYECHEME

Publisher:
Lyrics © HAITIAN MUSIC INDUSTRY, Downtown Music Publishing

Lyrics powered by Lyric Find

Styl-Plus

View Profile
Unbreakable Unbreakable