Villa Cassh - Main Tin

Money na the main tin
Without money you be nothing
Na dem go still tell you say
Money no be everything o
But without money
Dem no go value you
Dem go only dey with you
When dem see you with money
Many many things i want to cap
You way dey jobless dey check if i dab
Assshhh assshhh you be careless
Go find something do
I no go like form for here
I gas clear my mind for here
Many things i see men you never see nothing
Men shift my face turn me upside down
Bros before now i be no dey frown
The rain and the storm no fit carry me down
Check my dna you go see the blueprint
Hustle and motivate
God na the pay day i dey wait for
Am so stuck in the game
Am dragging my ice
All eyes on me like am rolling dice
God one time make e happen for my side
Make e be nice for my side
I don use jab pay the price
Money na the main thing o
Na the main thing o
If u nor dey find money
My guy your dulling o
My guy your dulling
My guy your dulling
Say the girls wey you dey see for club
Dem dey find the bar
If you nor get money
Forget there body o
Forget there body o
If the money nor dey for body ooo
My man call me v whats up
What's the way forward
Hommie this matter weak me
I don put all my energy
E come be like say nothing dey work
One day fynestalker call me
Bro you need work work
If mama go down
Who go give you food chop
I reason am i put all my effort
Og god bless see as you fresh
Capless assshhh focus
If you never hear from me ask first
If not for my story kporwell
Bros i no well i dey sick money sickness
If not for the bar what else
Maybe something else
Momsi know the matter
I don fast i don pray but the money no dey come fast
Tamuno i no say na you hold the remote
Make am fast
We need money way no get finish
Go club lavida e no go still finish
Lord making money the first thing no be sin
As far as am concern poverty na big sin
E no go be bad thing if you make am happen again
You yourself you know say money fit me
If na my sins dey cause poverty god forgive me
Money na the main thing o
Na the main thing o
If you nor dey find money
My guy your dulling o
My guy your dulling
My guy your dulling
Say the girls wey you dey see for club
Dem dey find the bar
If u nor get money
Forget there body o
Forget there body o
If the money nor dey for body ooo
Money na the main thing o
Na the main thing o
If u nor dey find money
My guy your dulling o
My guy your dulling
My guy your dulling
Say the girls wey you dey see for club
Dem dey find the bar
If you nor get money
Forget there body o
Forget there body o
If the money nor dey for body ooo

Written by:
David Douglas

Publisher:
Lyrics © O/B/O DistroKid

Lyrics powered by Lyric Find

Villa Cassh

View Profile