Benjiszzy Zaakii - Spotlight

Oh ho ooo
Son of the lion
Light, Camera, action
Designer clothe wey dey catch people attention
The crowd cheering loudly for every function
Last Last e dey sweet
But sometimes na distraction
Sometimes I dey feel like say I don loss my way
I dey ask myself if the cross nah the place I still fix my gaze
I won know if the things I dey do still dey put a smile on your face
Abi na the fame wey dey run my race
But help me to always remember
Help me to always remember
Help me to always remember
Say the real spotlight
Na the one wey you shine on me
Is it for you abi na for me
Is it for the accolades, abi na money
Na me dem dey see
Abi na YOU wey dem dey see in me
Fulfillment, sometimes I no know wetin e mean
(I no know wetin e mean o)
Whether na the show promoters wey dey call my phone
Abi na the many girls wey dey wan invade my zone
(Wey dey wan invade my zone)
Whether nah the bank alert wey no go fit to buy my soul
Abi na the hit songs? I no know
But help me to always remember
Help me to always remember
Help me to always remember
Say the real spotlight,
Na the one wey you shine on me
E, e, he, oh, oh
Help me to always remember say na for YOU
Hold me and help me to stand daily Lord for You
No let the fame enter my head
Help to remember say You be the baker
As I don dey get bread
But help me to always remember
Help me to always remember
Help me to always remember
Say the real spotlight
Na the one wey you shine on me

Written by:
Omale Zaakii

Publisher:
Lyrics © O/B/O DistroKid

Lyrics powered by Lyric Find

Benjiszzy Zaakii

View Profile